Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Kelly Ng
- Role, BBC News
- Reporting from Singapore
One Chinese-made artificial intelligence (AI) model wey dem call DeepSeek don shoot go to di top of Apple Store downloads, sometin wey shock investors plus sink some tech stocks.
Na on 20 January dem release am, but di tin sharply impress AI geeks bifor e even get di attention of di whole tech industry – and di world.
US President Donald Trump say dis na “wake-up call” for US companies wey must focus on “competing to win”.
Wetin make DeepSeek so special na di company claim say e build am wit small money compare wit wetin e cost industry-leading models like OpenAI – becos e use fewer advanced chips.
Di popularity of DeepSeek cause chip-making giant Nvidia to lose almost $600bn (£482bn) of dia market value yesterday – di biggest…


